Baba olowo the long pick by okafor


Episode 2 (oga my prick is no stand)
(a story for all my niggas)
As i pick my phone up to answer the call omo na him i hear shout ooo my guy my guy long time no see na
i say ah ah who be this
na so him remind me say na ur guy na half kilo
ahhhhh like so me i shout half kilo my guy how far na,wetin dey happen na long time no see
him con say me i just come back now from abuja to con see my family, where u dey now come my area here for festac na make we balling club na today na friday
ahhh me i say no wahala as far na flexing tins me i dey there no shaking
him cut the call oboy me i con dey reason am my guy make just leave us waka go hustle for abuja now e don show
e be like say pepe don rest for himside o baba don blow!!
Me sharpaly enter bathroom freshen up wear my fancy cloth spray my perfume oboy na club tins we dey now o!!
I come outside i rush go stand for bustop they wait for bus finally i con see festac side bus
like so me i fallen sharp sharp
i dey pray make i reach there at fast fast me i know get time to waist o today na today
oboy before i know i con notice say one man dey preach inside the bus abt natural sexual booster for men
the man just dey talk they talk how the tin go take benefit u and ur woman for bed
na so the man con ask abeg who go need this medicine before i come down
before i know i see two hands up
i look back wetin i see i know believe am
na one man with him son na only them raise up their hands
the man con say
oga abeg my prick is no stand!!!
Laugh won kill me inside bus chaiii which one be my prick is no stand!!!
U con know wetin the seller con
tell the man?
My friend dont worry you have
setanfujaasisiiiii
me i get the cure for it both u and ur son
ahhhhh which one be this one again o
for my life i never hear the name of this sickness before o
the seller con say my friend dont worry i will give u the medicine now for 500 naira only
na him the man open him bag comot one yamayama medicine me i never see before carry send am go last seat for the man and him son
na him the man as him collect the medicine him self con send the money front to the seller
na so the money take pass from hand to hand before he reach the seller for the front row
and na the seller bustop be that na so as him collect the money
the seller rush jump down gba!!
The conductor con say oya driver dey go
as we con dey go small time na him we dey hear shout for back of our motor
every body con dey look back wetin happen na
wetin make this medicine seller they pursue our bus like say na mad man him be
i con manage to listen wetin him dey shout for
the seller dey shout say na 50 naira the man give am instead of 500 naira
ahhhhhhhh laugh won kill me chaiiiii wetin be this
the man no even look back self
the man bone
me con dey wonder whether na the hands make dem pass the money convert the 500 to 50 naira abi na the man puposely bring out that 50 naira
oboy our driver no even send self like so him increase speed dey go
omo the seller no gree o but wen him don run tire body tell am to stop
na so all those women inside bus con dey laugh chaiiiiii what a wicked world
oboy na so me i take reach my bustop o apple junction
na so i comot my phone take halla my guy half kilo
him pick sharp sharp which side u dey na my guy
me tell am my location before i know it him don arrive con pick me up
oboy tins dey flow wella for here o guy
see fresh babes dem full every where chaii me go flex today die
na so we dey head go this 2face hotel rumors abi wetin dem dey call am self
oboy that place make sense die chaii if u no get money abeg hide ur face
we fallen like say we be boss every body they flex with their own babes
like so we relax con chill for one table
half kilo just make some few calls na him i see babes from different angles dey come our table
oboy today na die!!! Chaiii life dey sweet wen there is the money
like so 2 girls just con sidon near me like say na me call them come
me self just dey calm dey form boss
na so my guy just they order for drinks the thing just dey bother me somehow say half kilo no dey even ask for prize self
drinks just they flow for our table
omo na wen i take like half bottle
my forming boss spirit run comot
ewo na so i grab one of the girls they confess o baby i love u so much u are my everything
girl where be say i never see before for my life una don see wetin shayo dey cause abi?
Na so the groove just they move on the dj there just dey kill us softly with him bad boy music
guys dey everywhere they pop bottles ahhhh everytin set here
we dey there reach after 12 for night like so baba say him won go logde with him babes na
him go pay for 2 rooms him with them him babes dem me with the two girls wey i manage get
like so baba give them 80k for the drinks make we take o
oboy life dey sweet
we con dey head to lodge for rooms for the night
before i look back na so one bouncer grab me for neck chaiiii wetin happen!!!!

Comments

Popular posts from this blog

Diary of a rugged chaizman by nicheey.

Pooley girl (+18) ,a story by Linda

my nysc service, a story by mable