Diary of a rugged chaizman by nicheey.






Chapter 7.


Davidson: frank hwfa?

( seriously my mind no even dey here,i was almost shot.)

Victory: ahboy no tell me say na that thing wey just happen you dey reason so!.

Davidson: frank lap!.

( he said gesturing with his hand over a bed that two hard looking girls were seated.)

I carry my self jeje go sitdown for their middle,the room was hot despite the fast rotation of the ceiling fan.

Davidson: how e dey?.

(Sitting up on the bed).

Me:brotherly i blank. The thing weigh me.

Davidson: you do am any other thing?

Me:nothing o! Me wey even save am from una wrath sef. ( i said recalling how i ran from F and G to back gate.)

Davidson: him go strike again.

Me: i know.

Davidson: you no fit fight executioner,so how you wan do am?.

(The quiet weak me,if only this people know say na impersonation i dey do).

Me: i off!,i empty. My deck no dey here brotherly.

( i let out another lie,kai this time i cant stop lying)

Davidson:no worry bout your former deck,sail with us.

( like this guy dey tell me may i join m in return of protection??).

Me:brotherly? You sure?.

( i know why i ask.lol)

Davidson: na so e go be.

Me: no issues,as you yarn am na so.

Davidson: Aro!.

(He said clawing me).

The look on abel,caleb and emailed's faces was priceless.esppecially emmanuel lol,the guy wan go but no no how to take talk am.

Davidson: aro franko! Code name mayhem.rugged member of deck 007.

Immediately the new faces were just clawing me one by one,even lizzy.

Confidence: striker!when we go burst am rub?.

(Wait wait wait!. Burst who rub?)

Davidson: no need for that one,where him dey before e go don collect.

Davidson: you see this two girls beside you? He said.

(I looked at my left and right,the girls go well but no curves,no boobs. And the two even claw me sef.)

Davidson: any where you go they follow...

( he said bringing out a pistol from his inner jacket). 

So las las you don join another one for here ahbi?

Abel said to me while we walked to our hostel accompanied by the two girls.

Me: you don see am na

Emmy :what if R2 dey room?

Caleb: that one na win issue ooo,na him and Frank get issues no be me and am.

The talk weak me.

We got through the gate,it was quite embarrassing though,the girls kept following me from a distance.

Where em go sleep? Me wet dey try manage one small bed wey rsu gimme.

I sat down front of block F,the girls sat opposite the block. Quite a reasonable distance but this closed.

Crowds of people starting running towards our hostel gate with some siren at the back ground. No body tell me to lost. The way I banged my room door eh e remain small make e break.

Afone opened the for me. I didn't take time to shove him aside while i made way inside the room.

We were just 7 in the room that moment, the series of gun shots was so loud that we were taking cover under our bunk. Before bullet from no where Peirce through our ply wall.

Under the bed where I was with Emmy seem safe,at least for now...

I just needed to close my eyes a bit. No matter how much I try opening em the kept closing on dia own.

I woke up the under the bunk. No body bothered to wake me up. E pain me ehh.

I checked time it was 6:15 am. At least I never miss lecture.

I be dey brush wen Solomon call me say two girls dey room dey wait for me.

I weak,this girls still follow me come here ni. How em take know my hostel na number na.

As I enter inside,I sight everybody,including R2. Baba dey wear clothe like say nothing sup.

Him cooperate wey him wear fit m sha,but ehh this guy na two face oo. Who go believe say the president of computer science department na rugged cultist?.

Aha aha frank hwfa. Na waytin comot from him mouth wen him turn see me.

Baba I dey oo,how e dey be. I reply m back immediately, shoving aside the memories of last night when he tried to kill me.

I fit borrow your belt?. Him ask with concern. My belt ke. A whole president no get belt?. No yawa na use m,I said to him while I made out of the room..


Comments

Popular posts from this blog

Diary of a rugged chaizman by nicheey.

Pooley girl (+18) ,a story by Linda

my nysc service, a story by mable